DANIKINGS-STREETZ-GOSSIP'S™

™........................ Your Daily Tonic ...................... ™

Tuesday, 24 December 2019

Proverbs From The Streets Of Warri.

Make una use am dey spice una weekend. Na straight from the streets of Warri…053, area!!!

Dem nor dey tell small pikin make e nor grow big teeth but na to still grow big lips to take cover dem.

Man wey nor get money to buy drink for beer parlour dey quick contribute for other people matter.

Man wey dem give change over for shop no dey waka small small dey go house.

Pikin wey say na agbada em want take start guy go talk wetin e go wear when em old.

Snake wey say na tortoise back e wan bite get enough money to see dentist.

No matter how yansh make yanga reach, legs go still first am enter house.

Olosho die, private part rest.

The food nor sweet, the food nor sweet, nor be for Ukwuani weed.

Na say goat know say the waka waka for life plenty make am wear em own shoes come earth.

If money nor reach to take marry dem go use am play love.

Say blind man no fit see the sun no come mean say the sun no dey exist.

Dem say beauty is in the eyes of the beholder no mean say we go toast babe wey resemble monkey wey lick lime.

Na man wey no get power dey run go house go pull shirt when dem find em trouble for field.

Na too much groundnut oil make puff-puff shine pass buns.

Small pikin wey dey ask e papa every time why e no build house, e go soon reach em turn

No comments:

Post a Comment

Daily Amebo

15 Profitable Businesses You Can Start With Just ₦70K In Nigeria

Business Plan Outline your goals, target customers, marketing strategies, expenses, and projections to provide direction for your business. ...